Thursday, 26 February 2015


Saka Don Yarn Say No Shortcut To Success

Mr Hafeez Oyetoro Wey Everybody sabi as Saka don advise all the Ogbonge youths to work hard and make them avoid APIAN-WAY to success.
As him kon sit-don with Nigeria television Authourity(NTA) they talk about the mata, him kon say make "the youth of today TANDA their small mind focus on wetin dem  sabi  do wella becos HARD-WORK they pay ooo,"Him talk am during the TV interview.


Mr Hafeez Oyetoro kon still salute the Nigerian Movie Industry Practitioners,Say the industry don lay better foundation pass the wey him dey be before.He also still yarn say the industry don make sense wella in terms of PICTURE QUALITY,SOUND,LIGHTENING,GRAPHICS AND FILMMAKING."na Saka talk this one.




Mr Hafeez Oyetoro na Comedian and him na theatre Arts practitioner.They born am for Adegbola town of Iseyin Local Government Area of Oyo State,Nigeria.Him na lecturer for Adeniran Ogunsanya College Of Education Ottor/Ijanikin,Lagos State.



by campusdigestMOUAU

No comments:

Post a Comment